Friday, June 8, 2012

Invest For Naija



Riot de for Onitsha
35 don die
Dem de revenge
For the 58
Wei die for Maiduguri

Ijaw boys de riot
For Warri side
Dem de revenge
For the 15
Wei die
For Ekerenkoko

Dat one sef
Na revenge
For de thousand
Wei die for Odi

Dem no de tire
For revenge
Only for thank you

Charlie de London
De find
Foreign investor
Make dem bring money
Come put for Naija

De introduce im boys
Make dem fit enter
Global banking!
Humph!
Naija banking
No be Swiss banking o!
Oyibo na mugu!

NG baby de finance
De cry say
Her market don spoil
De profit don less
Shell don run
She de pray
Make dem settle
Quick, quick
Thank God say
Foreign reserve de
It still de so?

Anyway

Baba de talk say
Boys do bad thing
De behave like say
Problem de for country
De allow criminal
To thief we oil
Na him we de talk now!
Say na we oil
Abi problem no de?

Wei de criminal de sef
E de for creek
Abi im de for rock
Me no come sure

Waffi boys
Dem eye don red
Abuja de shine
For desert o!
Dem backward for water
Come de dirty
Idle mind
Na im de worry dem
I agreee
Dem no get job now!
Which one be dat

For America
Dem get Capitol Hill
For Naija
Na Capital Rock
Na im we get
Na hard thing be dat o!

I wonder o!

 © Lesley Gene Agams        February 23, 2006

No comments:

Post a Comment