Friday, June 1, 2012

Observer and Monitor





All these big big grammar people
Which one dem de talk sef
Say observer na monitor
Abi na monitor be observer
Dat dictionary dem de find
De we country now haba
We know monitor now
No be the one wea de for class?
Ehen now
Na him de control the class
De blow report for teacher
Observer no fit talk
Na look im de look
Sidon look na monkey name
Kongi de blow grammar for we
Like say im no know
We own Naija grammar

Im no like dat farmer sha
Before that one
Im no been like dat general
Before that sef
Im no like dat dribbler
Im no like anybody sef
Even Jesus im no like
Mohammed sef im fit no like
Me no know sha
As for oyibo grammar
Im know dat one well well
Na im be de master for am
If im call am e go answer
Cotton wool don full im head
Na elder im be

For Naija we de respect our elder
Na so dey take code we
From small pikin
Na fear dem de take train we
To fear elder na there wisdom start
Dem no de spare rod o
Dat na de juju
If you shine your eye
Your eye go come clear
You go see de feet
Of de masquerade
Fear go gree you look?
You go see say
Na clay dem be
Like Nebuchadnezzar for Bible

Lesley Gene Agams Sept 18, 2005 Abuja


No comments:

Post a Comment